Moral lesson: get coach wey sabi study game.
Argentina coach see say Egypt give space for wings so anything wey make am switch to 4-3-3 e go win di match.
Baba remove De Paul, make Alvarez , Martinez and Messi dey front , Messi dey enter RW once in a while.
Na wetin follow help Argentina today but..
Yesterday, Portugal coach leave Ramos wey give am winning goal against Croatia, striker wey get 4 Worldcup goals, even if na 15 mins e no gree give am.
As e put Leao e suppose put Ramos join but e no gree maybe e dey fear dragging or wetin people go talk, na why I like Mourinho, wetin people dey tok no concern am.
E don try Vitinha, Neves and Bruno combination and e no work, baba suppose change style e still no change.
Na that coach kpai Portugal Worldcup dream..