lordkenzzy Posted 4 hours ago #1 Posted 4 hours ago Moral lesson: get coach wey sabi study game. Argentina coach see say Egypt give space for wings so anything wey make am switch to 4-3-3 e go win di match. Baba remove De Paul, make Alvarez , Martinez and Messi dey front , Messi dey enter RW once in a while. Na wetin follow help Argentina today but.. Yesterday, Portugal coach leave Ramos wey give am winning goal against Croatia, striker wey get 4 Worldcup goals, even if na 15 mins e no gree give am. As e put Leao e suppose put Ramos join but e no gree maybe e dey fear dragging or wetin people go talk, na why I like Mourinho, wetin people dey tok no concern am. E don try Vitinha, Neves and Bruno combination and e no work, baba suppose change style e still no change. Na that coach kpai Portugal Worldcup dream..
Featured Comment
Create an account or sign in to comment
You need to be a member in order to leave a comment
Create an account
Sign up for a new account in our community. It's easy!
Register a new accountSign in
Already have an account? Sign in here.
Sign In Now